Face 2 Face

Face 2 face episode 6 – finale

Face 2 face
Episode 6
konami: iyabo abeg your wahala too much
daniel: iyabo, you’re too young to be patronizing pr-stitutes, better present or it might be too late
papa iyabo: abeg pastor daniel tell am o
mama iyabo: tell am wetin?
Papa iyabo: tell am to repent
mama iyabo: i hear, abi nobi you teach am?
Iyabo: yes na true, na papa teach me
idris: kai wetin dey happen here na? Abi i dey craze?
Konami: oga val i think we don finish introduction o, na the next face we dey wait for
oga val: na so i dey see am o, but these people wahala don dey too much abi you want make we put law for s€×?
Daniel: yes! s€× is a sin, from now on nobody should have s€×
Idris: kai! Tufiakwa! Allah forbid bad thing, say body na firewood?
Oga val: one dey we go enforce the law
konami: no wahala oga val
oga val: whats the next agenda?
Konami: this one you don dey scatter my head with grammer, no kill me o.
Area mama: useless man, e mean say wetin dey ground
konami: better no tamper with my patience if not by the time i go finish with you, you go hate only my name
oga val: you mad? You well at all?
You don for say na my wife you dey talk to? A wh0le area mama?
Konami: abeg area papa drop that thing jor, who area mama elp self?
Papa iyabo: oga val abeg do fast make we go sleep tomorow na business day
soma: i don later for rehearsal o
mama put: abeg o make my food no sour o
idris: make thief no jump gate o
talent scout: i don dey late for my night gym
oga val: abeg e don do, oya konami continue
konami: since we don finish with all our talk, the next na the ceremony
captain spoonz: na so oga konami, ona now you dey talk, nai make i like you
papa iyabo: spoonz shut up there, na food ona sabi
konami: spoonz no mind the idiot, e dey talk as if, if e see the food e no go chop {to mama put} oya bring in the food { to mama iyabo} abeg bring the ogogoro them come and abeg no forget to bring my favourite lemon grass and monkey tail
iyabo: {to carpenter} last time e drink finish fall in,side shit pit, today who know where e go fall
carpenter: hahaha who knows if e no go fall in,side fire sleep
iyabo: you don forget the dey e nearly rape your chicken?
Carpenter: just as e nearly rape your grand papa goat?
Iyabo: mtaheew! I think say i dey talk to person i no know say na animal i dey talk to
idris: iyabo belike you no get respect again abi?
Iyabo: you this useless aboki shut up
idris: i dey craze? You want make i tear you slap?
Just then mama put and mama iyabo returned with the items konami ordered for
mama put: time to jolyjoly
konami: i hope you no put poisone for this food?
Mama put: make devil punish that your mouth
konami: i know but atleast you must taste the food before we go chop am
mama put: you say wetin?
Konami: you no dey hear english? Oya idris interprete wetin i talk to her belike her ears dey pain her
idris: mama puuutuu, konami say, say make i tell you say, say make you taste the fooduu you bring come before we go chop am
konami: oya mama put, we dey wait o
EPISODE 7
.
.
CONTINUE FROM LAST SCENARIO
.
.
.
Mama put: wait for wetin?
Konami: for you to open the food na
mama put: {opens food} oya i don open am
papa iyabo: {inhale and exhale air and salivates} ahhh
captain spoonz: {hiss at papa iyabo}
idris: useless Bastards
konami: oya mama put chop am na
idris: make ona do na
konami: do wetin?
Idris: useless bastards
konami: your mama and papa
captainspoonz: ona don start abi!
Konami: no mind this our useless aboki gate man here
idris: kai na me you dey address like that? I dey craze? I dey mad? Infact konami make you shit eggs there
konami: papa iyabo warn am o
papa iyabo: make devil shit for that your fowl yansh mouth
konami: mama iyabo i go kill person for here o
mama iyabo: na so i dey see am o
iyabo: abeg make ona fight i wan see who strong pass
talent scout: iyabo wetin you talk?
Iyabo: come o , na who you just call iyabo?
Talent scout: how many iyabo we get for this compound?
Iyabo: if you ask me , na who i go ask?
Talent scout: {slaps iyabo}
iyabo: heeeee!!! You get mind slap me bah?
Talent scout: yes
iyabo: oya wait and see
talent scout: wetin you go even fit do self?
Iyabo: {exist the hall}
konami: small brat, like papa like son, kai , oya everybody make we eat jor, this one mama put don taste the food
captainspoonz: oga val , abeg we still need some prayers o
oga val: for wetin?
Captainspoonz: for the food
oga val: na so my guy, you make sense well
mama put: na my food ona wan pray for abi?
Oga val: na so spoonz say make we do o
mama put: why?
Konami: to kill any juju in,side
mama put: you mad
captainspoonz: no mind the idiotic bastard, the reason na to bless your food
mama put: eh eh na now you dey talk, infact spoonz make God bless you well well
captainspoonz: amen o
konami: spoonz na me you get mind call ii…ii…ii…idiotkitic baztards?
Captainspoonz: i no mention name o
mama put: na so o my brother, you no mention name
oga val: oya idris pray for us
konami: oya everybody eyes close
idris: in Jesus name, baba, allah, God, we pray this evening say as we wan choppuu this wu…wu…woman food, make you put poisone proof for our belle so that any poisone wey bokoharam don put no go see us and also make papa iyabo start to fat and make konami stop to drink, make mama iyabo repent, Amin!!!
Talent scout: {scre-ms} Jesus!!! , iyabo you get mind soup me water abi? You go enter six feet today
idris: allah don answer my prayers.
Continue from last scenario in episode 7
.
.
.
.
.
Papa iyabo: talent scout or anything you dey answer, you say wetin?
Talent scout: i say iyabo dey enter six feet today
iyabo: na your papa and mama dey enter am not me
konami: {wispers} see live film
captain spoonz: this people funny die
konami: na so dem dey do every time
oga val: {to captain spoonz} bro no mind all these mad people wey dey stay for this my compound, na so them dey worry me and me self don tire for them
konami: idris!!!
Idris: wetin come be your own again?
Konami: start to share the drink jor, forget those people wey dey fight, we no go follow because of people wey dey fight starve ourselves to death while food dey our front
mama put: kpam! Konami, na today you talk better thing jor
soma: konami belike idris prayer for you work well, abeg idris keep on praying for him
igwe: {clears throat} please o, make ona do fast, i wan go patronize sommy angel
konami: make olosho kill you there!
Igwe: {to konami} you say?
Mama put: iyabo don book her na, why you still wan patronize her?
Igwe: who be iyabo again?
Mama put: na johnsky na abi you don forget?
Igwe: oh! You mean that small rat wey no fit wash e p-nt clean?
Konami: {laughs} walai wahala dey o
mama put: small rat wey no fit wash e p-nt clean and yet you wey fit wash you own p-nt clean dey follow am drag for one olosho, chai! Wonders shall never cease to end
konami: na true you talk so mama put dencygirl, imagine you dey say pig dirty but yet you still dey follow the pig play for e dirty mud. Isn’t that one of the biggest egbelemateaur of the century?
Idris: {shouts} chai my far don burst, konami na you just blow one great wizard gramma?
Mama put: egbebe-lele-mama-teaur…..
Idris: ……of the highest order
igwe: thank you very much
konami: you don welcome bro
just then there is a commotion where they were fighting
iyabo: make ona hold me fast fast before i go kill person o
talent scout: kill your papa idiot
{bottle burst and shattered from the direction of the fight}
konami: oboy igwe abeg make we go hold person before this compound go catch fire today
oga val: oya make ona stop all this rubbish if not i go call police to come evict ona
captain spoonz: oga val, abeg if you get cow tail for house bring am come make i use am now
oga val: you wan use am do wetin?
Captain spoonz: i wan use am clear those cows their head
oga val: you wan worsten the wahala abi?
Captain spoonz: no o , i just wan help settle am quick
just then, idris appeared with a cow tail
idris: spoonz here take am clear their doubts!!!
After idris gave captain spoonz the cow tail {koboko} and there was lots of tension…
The end….

Back to top button
Close

Adblock Detected

We plead you off your AdBlock on this site, as it kills the only source of it income.