Face 2 Face

Face to face episode 2 & 3

Face 2 face
Episode 2
the next day, captain spoonz and musty both dressed up in mufti like area boys to coolval villa to seek for the apartment . Getting near to the compound they came across konami.
Musty: {calling} mr , mr, here na coolvilla?
Konami: no oo, here na hotvilla o
musty: how you take mean?
Konami: here wey you see so,katakata dey o, infact na stone me punch i bomb you slap compound we dey o
captain spoonz: {interested} oboy here go sweet to stay o
musty: captain you mean am?
Captain spoonz: {red eyed} wetin i tell you for camp?
Musty: sorry o, mr spoonz
captain spoonz: na now you dey come
musty: {to konami} wetin be you name self?
Konami: my name na konami, the one and only konami for this compound cause am the rugged game boy
musty: abeg pocket that your sermon there carry us go see you land lord
konami: how much you go pay me?
Musty: you say wetin?
Konami: i say how much you go pay me?
Musty: pay you say which work you work?
Konami: wait o, you expect make i trek from here go in,side compound on an empty stomach bah? Abi motor dey work without fuel?
Captain spoonz: okay we go pay you, just take us to your land lord
konami: eh eh na now ona dey come, oga you be man jare, no mind this c*ckroach wey stand there
musty: chai na me you get mind call c*ckroach abi?
Konami: i no mention names o, any way come make we dey go
They all went to the gate and konami started blasting the gate with mad frenzy
musty: why you dey blast the gate like that?
Konami: because our useless aboki gate man by this time go don put on ear piece dey listen to sahara news network
konami continues knocking
idris: { from the in,side } na who be that mad man wey won tear down this gate so that oga val go come sack me?
Musty: na your grand papa
idris: {from the in,side} wait o, konami how many times i go tell you not to mention my grand papa again? Abi your one shot don dey make you kolomenta?
Konami: idris make ajumoimoi sack you there, you no fit recognise my voice?
Idris: {opens the gate} so now you don bring in two more wahala come, this our peaceful compound abi?
Musty: {laughs}
idris: so you dey busy dey laugh abi? No worry when mama iyabo p-nt go lost this night again na you dem go crucify
musty: why?
Idris: papa iyabo say e won voke juju for the person wey dey thief e wife p-nts
captain spoonz: {to konami} abeg konami take us to your land lord jare
konami: yes oga
they made to leave but idris called them back
idris: hey! Ona don forget ona gate fee?
Musty: which gate fee again?
Captain spoonz: {not wanting to waste time} how much?
Idris: hundred naira
musty: how many hundred?
Idris: one
musty: take! {hands him the money}
they all exist the gate into the compound except idris the gate man
Episode 3 [unedited episode]
Getting into the main compound, konami quickly point out
konami: see that for there, na famous the meat seller house be that, that one painted red na soma the choir girl side, then there na mama and papa iyabo zone be that.
Just then, musty read out a sign post
musty: “mama and papa iyabo zone, please keep off to avoid unwanted wahala”
konami: na their zone be that o and any moment from now just expect quarrel…
As if it was a clue for musty and captain spoonz to understand konami’s point, papa iyabo came out and started shouting
papa iyabo: na who thief my wife scot last night? I go voke juju o
konami: papa iyabo, wetin again na abi person no go hear word this early mor mor again?
Papa iyabo: wait o, you well at all?
Konami: abi you no see guests?
Papa iyabo: {noticing them} oh ona welcome o, welcome to coolval villa where my wife’s p-nt is always missing
konami: you dey mad! If your wife’s scot dey always miss why you never relocate?
Papa iyabo: useless drunkard you don come again o, if i catch you eh…
Konami: …wetin you go fit do?
Papa iyabo: i go destroy you
konami: na talent scout the boxer i go send for you, abi you wan try? Just touch me hand make i see!
Musty: abeg e don do o, konami oya take us to your land lord
konami: abeg leave me make i finish this mad man, every day e wife p-nt dey lost, e get any day e don ask e wife how she dey carry keep the p-nts?
Musty: konami e don do na
konami: okay oga if to say nobi you eh, i for show this bastard something e for no forget easily
papa iyabo: no worry na, we go see
papa iyabo retreated back into his house while the three men proceeds towards the land lord’s house
@@@@@@@@
konami: {knocking} oga val you dey house?
Oga val: no o, i dey bush, by the way , na who be that mad man wey no go allow man pikin to sleep well this morning?
Konami: haba oga val , you no fit even greet your guest good morning self?
Oga val: wetin good about this morning self?
Musty: area papa i dey greet o
oga val: {dropping an eye brow} yes…mr man na who you be self?
Konami: them wan rent house o
oga val: okay na no wahala, give me a minute make i come back
oga val entered into his room and return back with a note
oga val: here {hands musty the the note}
musty: {reads the note} payment for a month is five thousand naira?
Oga val: {raises an eye brow}
musty: spoonz wetin you get to talk ?
Captain spoonz: no wahala book am
musty: okay, and oga val na block 3D we want o
oga val: no wahala, but that side e don tale since person stay there so e go need small work
musty: no wahala, how much?
Oga val: to repair and work everything to be in a perfect shape na 5k o
musty: no wahala
oga val: then we go need 2k for ceremony o
musty: which ceremony?
Oga val: membersh¡p ceremony
musty: okay na, no wahala. Take this 12k
oga val: thanks, welcome to coolval villa…
Konami: …where wahala dey always dey

Back to top button
Close

Adblock Detected

We plead you off your AdBlock on this site, as it kills the only source of it income.