My WhatsApp Visitor

My whatsapp visitor episode 37

MY WHATSAPP VISITOR 18+
Episode 37
I waka go back go meet my bro wey dey stand for the front of the filling-station, immediately he saw me.
Victory: you don collect the number?
Me: mission impossible.
Victory: how?
Me: her boyfriend na drug lord.
Victory: *he start laughing* em see you.
Me: na you sabi.
I remembered that I had to see Victory that evening, so that we go talk. She fit be my temporal girlfriend who knows?
We waka enter my street tarred road, na the only street wey get road wey person no need to be athlete to go where you wan go.
Some niggas dey smoke by a shop, I first wait make we enter the street wella before I bring out my phone to call Victory, I called her twice before she come pick.
Me: hello my love.
Victory: are you not coming again?
Me: no na, I dey come towards that place wey them dey sell kerosene along the road.
Victory: when you reach there flash me.
I ended the call. I started hearing splashing sounds of water, I look my left come dey see women and men at work.
A man was removing water from the church compound, I come dey wonder naso them godey do everyday wey rain go fall.
That place na water wife.
Me: you go carry all these things go house, I wan see somebody.
Victory: na you go cook the soup?
Me: no, night don dey cover. Kukuma cook am.
He took the fuel rubber and the soup things I bought from me, while I dialed Victory’s number.
Her phone started ringing, I come dey wonder if she don dey wait for me for that kerosene place already.
Victory: good evening.
Me: my love.
My brother left us alone ’cause na private matter.
Me: why are you doing me like this?
Victory: like how na?
Me: you just dey take my love for granted.
Victory: I no understand oh, I never do anything.
Me: you know say I love well well, allow me be your boyfriend. I swear I go always love you.
Victory: okay oh, my think about am.
I hold her hand and look deep into her eyes, that time. Na the time one man was drive em car pass us, I just free the babe. I still new to the area before somebody papa go harass me because of em daughter.
Me: nothing to think there, just say yes and I will make you my queen.
Victory: okay, yes.
I hugged her tight. Her bre-asts soft die.
Victory: come make we dey go our shop, my legs dey pain me.
 
Me: anywhere you wan carry me go, I go follow baby.
She held my hand and took me to the place that they were selling kerosene along the road, I no realize say na them dey sell the kerosene.
 
As we wan go sit down for the fence one man use fence em land against property draggers association, Naso I sight one woman wey dey sit down close to the lantern they hang for the small kiosk shop.
 
Me: ma good evening.
 
Victory: mommy, meet my friend Victor.
 
Meet who?
Mom Victory: evening, ehnn.. Victory go bring water for me from house.
 
Victory: okay, mommy. You go follow me?
 
Me: no, I wan go house.
 
Victory: now now.
 
Me: no vex, I go come tomorrow.
 
Victory: mommy, I wan esc-rt my friend.
 
Mommy Victory: come quick oh!
 
Me: ma goodnight.
 
Mommy Victory: greet your parents oh!
 
I smiled and simply replied “ehnn” we stepped out of Victory’s house road and then climbed the tarred road that served as the street road that led to our house.
 
Victory: greet your mother for her oh! *she chuckle*
 
Me: I dey live alone na, I be big boy.
 
Victory: okay oh! big boy, you fit waka for darkness dey go house alone na.
 
Me: you never even esc-rt me go anywhere, you wan go house.
 
Victory: you know say my mama send me message, I no want make she hala me.
 
Me: no problem, what of goodnight hug?
 
She hugged me sharply and pressed the soft oranges on her chest to me, the softness sent a thrilling excitement all over my senses.
She ended the embrace when my middle leg started kicking.
She turned and walk away, I stared at her retreating shaking back side.
 
Me: what of good night k-ss? *I call out to her*
 
Victory: when I come visit you *with raise voice*
 
I smile that visiting godey memorial, I went home and met my brother in the kitchen still cooking.
 
Me: you dey cook chimpanzee, this one the soup never still done?
 
Victory: I dey cook special delicacy, go sit down when em done you go confirm my weight.
 
Me: *I hiss* no waste gas oh! Because I no get money to go refill another one.
 
I left the kitchen door opened and went in,side my room, my feet were aching somehow.
I just felt tired, I pulled off my shirt and took off my trouser.
Wore only boxer, I forgot to ask Man U score with Norwich.
 
I went back to the kitchen and met my brother pounding fresh pepper.
 
Me: wetin Man U play na?
 
Victory: four zero.
 
Me: who and who score?
 
Victory: Victory one, Victory two, Victory three, Victory four.
 
Me: talk truth, I play to score. Just tell me.
 
Victory: you no get phone to check? I pay fifty naira to watch the match.
 
Me: *i start laughing* you go leave bet9ja office to watch the match go dash person money.
 
I sighed and str-de out of the kitchen and entered my room, closed the door and laid on the bed.
I was so tired that I didn’t know when I slept off due to stress.
 
Another dream of Sandra came again..
 
That her sweet voice, she came out of my apartment laughing. Me sef dey stand for the verandah tryna lock the door.
We held house gisting and giggling, we just dey waka dey go for road.
 
We waka commot from our street and entered the tarred road, I no see any single soul even when we pass one shop like that and Angel their shop. I no see anybody, I come dey expect to see Lizzy.
 
I no see her, we waka go the junction wey we dey board keke napep for the area.
She started waving one stop.
 
Me: where we dey go, baby?
 
She turned to me and started smiling, her face started fading and everything became blur, I opened my eyes to see my brother tapping me to wake up.
 
Victory: come eat oh!
 
TBC…

Back to top button
Close

Adblock Detected

We plead you off your AdBlock on this site, as it kills the only source of it income.